I Go Dance

Sammie Okposo

Shey abegi make una no mind me oo abeg Because I wan scatter dance now Aah hehn no be drink dey worry me oo hehn The thing wey dey shark me now ehh E pass ogogoro Because if I tell una how Baba God take change my story Ehehn una body no go contain una oh Una go begin dey follow me dey jolly Oya Sesele chey sesele chey sesele oya oya Sesele chey sesele chey sesele ehhy Everybody danceya ehehn danceya ehehn danceya Ehhy everybody danceya ehehn danceya ehehn danceya Na so Many years don come and go Everyday with im own story oo oh The place wey I dey yesterday I no de there today oh oh oh I know say I no qualify Papa na You justify me oo ehh ehh My mistakes You rectify Forever na You I go magnify ehh ehh ehh Wen I dey wahala You say no palava ehhy You say if I surrender and make You my Father ehh ehh ehhy All my suffer don pass over ehh I begin de hammer I come dey hala Na God de power For the things He dey do for me ehh I go dance I go dance oh He dey sweet for my belle iyea ehh ehh ehh I go dance I go dance oh You don change my story oo oh oh I go dance I go dance oh You don make my life better ehh ehh ehhy I go dance I go dance oh Oya sesele Sesele sesele sesele sesele chei chei Sesele sesele sesele sesele sesele Everybody danceya danceya danceya danceya ee danceya danceya Everybody danceya danceya hahn danceya Not to small thing Dem say I be zero ehh You turn me to hero ehh Dem even say I be failure chei You Love me with favour ehh For all my trouble ehh ehh ehh You bless me double oo ehh Some say I don dey magaa na God dey ginger my swagga The things that You do for me-e-e-e e dey sweet my body ehh ehhy How You die for me and You set me free e de make me jolly ehh All de thing wey You dey do for me yeah ehh ehh e de sweet my body ehh ehh All de thing wey You dey do for me yeah ehh ehh e de make me jolly ehh ehh You don change my story ehh I go dance I go dance oh My life don better I go dance I go dance oo E dey sweet my belle I go dance chei I go dance oo E dey sweet my belle yeahh ehh ehhy I go dance I go dance oo Jolly jolly jolly I go dance ehh ehhy I go dance oo Jolly jolly jolly I go dance ehh ehhy I go dance oo Ehhy sesele sesele I go dance sesele sesele I go dance oo Danceya danceya I go dance danceya I go dance oo ehh You don change my story I go dance yeah yeah I go dance oo Ehhy unekunek sai unekunek I go dance unekunek I go dance oo unekunek Oya wave your hands and I go dance shake your body I go dance oo Oghene meh You do well oo oh oh yeah I go dance I go dance oo Iketummeh You too much oo I go dance chei oya I go dance oo Sesele sesele sesele sesele sesele sesele ehh Everybody danceya danceya danceya danceya hei Danceya danceya chei chei chei

Written by: Sammie Uyi OkposoLyrics © TUNECORE INC, TuneCore Inc.Lyrics Licensed & Provided by LyricFind

Create your own version of your favorite music.

Sing now

Kanto is available on:

google-playapp-storehuawei-store