Ah ah ye ye
Aya ye ye ye oh
They call me Jumabee
Damelo Wayne
You dey for America
And your mother dey for Lagos dey fry akara
You dey spray your girlfriend some dollars
And your younger sister dey for street dey hustle jankara
Your children no chop last night and you dey for hightable dey smile in your ankara oh
You buy bigi motor for your girlfriend and for area na leg your wife dey use japa
Hey mister man ogalema ogalema ogalema ogalema
Ogalema ogalema ogalema ogalema
If no be one thing I for say make this life start again
Let the rich be poor and the poor be rich again
Na that time Mr hmm hmm go turn born again and praying for his money to come back again
Oga the time wey you go die your golden rolex no fit tell you
Why you so stingy and na God bless you
I know one man o he was a billionaire but when him die him get nobody gree to near
When you dey alive dem go dey hail you
And when you peme na dem go still bury you
Chairman sir, policemen full your back
But when e set even dem go run from attack
Before before na MKO now dey talking Dangote
Nobody knows tomorrow money bring joy and sorrow
So my brother cool down no carry chest up
Hey mister man ogalema ogalema ogalema ogalema
Ogalema ogalema ogalema ogalema
Hey sister! Why you dey borrow hair to slay
When all the men wey you dey find just wanna lay
And after wey dem lay dem delete your number same day
‘Cause dem just wanna use your destiny bake cake
You wan use your mama do blood money
You no know say na because of her you need this money
And if you get am wey she no dey what’s the essence my padi
When the consequences come sef no be say you ready
Hey mister man ogalema ogalema ogalema ogalema
Ogalema ogalema ogalema ogalema
Life they say e no balance eh
But na we dey use we hand do we sef
Easy lioness no duttiness
They don know
Damelo Wayne
Written by: Lyrics Licensed & Provided by LyricFind
Create your own version of your favorite music.
Sing now